Tu Baba Waka Go CLose To Boko Haram

Kingsley Momoh
Tu Baba don show say no be only to dey sing and born pikin he sabi pass. The ogbonge musician don show say him sabi many things as he carry himself go visit internally displaced persons (IDP) Camp wey dey Banki, close to Cameroon Republic and other resettlement Areas for Maiduguri, Borno State camp for Banki, Borno State. The guy no just rush go there as we hear say he spend 3 days for the visit.
Tu Baba talk asay he dey pain him to see when people dey suffer especially for wetin no be their cause. Tu Baba talk say the fight with Boko Haram by gofment no be because of religion or where anybody come from because na so some wuruwuru people dey talk. He say make we no believe those kind talk but make we come out to helep people wey need our help.

No comments

Powered by Blogger.